Thursday 30 April 2015

Divine Deletion: I Sabi Well Well, Say One Day I Go Die …..

CAUTION: This be death matter.

"Cooking and frying, only news of the fire wey them hear, ibi roasting; wey see the fire naked."

Everyday for our life people we sabi dey die, ibi like news we dey hear (cooking and frying through life) as death land for your top, ibi that time man go see naked truth about dis life we all dey hustle through.

Whether na metaphor, hyperbole, onomatopoeia, allegory or anything your literature/grammar teacher call am, DEATH na one word wey get plenty idiomatic uses – I suspect say death like gari be ubiquitous, no dey stay one place so, so roaming wal Laahi (I swear).

One time, na bucket someone kick, then another time for ‘life highway,’ someone pass away or pass on, some self say ibi visit to ancestors. One quotation I sabi well well about death be: De black camel wey dey stop for everybody gate mouth if no bi today, for the future. Camel see matter ooo

Reality [call am true matter] be say, whoever you be now (present), you be before (past) or you go be for the later (future); somebody like you – for past, present or future – die before, die as I dey write wey you don dey read, or go die later.

Shebi na man/woman, light/dark, tall/short, rich/poverty don, sick/strong etc. you fit die anytime, no be you alone even me: na die I go die someday me too.

I sure say, this no be issue wey people go dey want to yab yab for top, but … as ibi inevitable phenomenon – na im be say everybody wey mama born am go die, I beg read if you want. If not, no be me go advice you wey thing to do.

A- Ah! Shebi, no be me for wish you dead, why at all I for do dat?

After all me too go die someday. But as i dey so, I just want roll am for my head say: One day if I die, weything go happen? Seriously this na BIG question even you too for start dey toss for inside your head.     

I no sabi why, but so them dey say: that as person die pam, you for no talk any evil about am. But what I sabi be say: whoever you be, just die finish… bam! Some people go talk good, others go talk bad, then the middle batch, just go dey there indifferent.

The reactionary reaction towards your ‘mutuwa’ (Hausa for death) all go depend on how you relate plus them [fellow man], the time wey you still dey fit breathe air courtesy Oga God and HIM boundless providence and grace.

Some go hear about your death immediately (shebi social media dey), some go hear am days, weeks, months even years later, trust me; some never go hear till them too go die. But all that no be matter ooo. So i see say you want yab say "what be matter?" True matter be the obedience, respect you give to Baba God. Then the way you live plus your fellow son of Adam. Period! Matter be dis oooo....

As for me, I sure say if I die, my mama and siblings [2 brothers and 3 sisters go cry] – this I sabi sake of how me plus them collaborate to cry as wanna papa die. Other relatives for de family go cry, some school and makaranta colleagues go cry and I sure say the kiddies wey I dey teach and those i teach for past too go mourn big time.

Seriously, all of that no go help in anyway, it just go be say, them spare some optical fluid coz as you go, them never go see you again. At that time too, dead body – renamed corpse – no go know who dey cry or who happy say you die. Coz na die you die be that!

As I want exit dis world on good level plus God and mankind – wherever I find my body; I dey guide myself with this principle: LEARN RIGHT, SABI AM WELL WELL THEN SPREAD AM TO ALL AND SUNDRY.

As Baba God bless you, die go; people go mourn you but you go dey enjoy fine fine meeting with ALLAH.

Peace!  

11th Rajab 1436 = 30th May, 2015

No comments:

Post a Comment